Advertisement
*SERMON TITLE: THE POWER IN THE BLOOD OF JESUS**ANCHOR TEXTS:* Leviticus 17:11, Revelation 12:11, Hebrews 12:24, Exodus 12:13
*INTRODUCTION:*
Brethren, life is in the blood! If blood comot for man body, man don die. That is how spiritual life be - if Jesus no shed His blood, we for don die forever.
Many Christians dey pray long prayer but dem no sabi use the weapon wey God don give us - THE BLOOD!
*THERE ARE 7 REAL POWERS INSIDE THE BLOOD:*
*1. POWER OF FORGIVENESS (Ephesians 1:7, Colossians 1:14)*
- All our sins, past, present and future, blood don wash am.
- No sin wey blood no fit wash. Even if your own red like crimson, blood go make am white like snow (Isaiah 1:18)
*2. POWER OF REDEMPTION & LIBERTY (1 Peter 1:18-19, Galatians 3:13)*
- Jesus use His blood buy us back from devil market. We no be slave again.
- Every curse from father house, mother house - the blood break am.
*3. POWER OF JUSTIFICATION & ACCESS (Romans 5:9)*
- By the blood, we now have boldness to enter Holy of Holies (Heb 10:19)
- You no need priest again to talk to God. Blood don open door for you.
*4. POWER OF HEALING & WHOLENESS (Isaiah 53:5, 1 Peter 2:24)*
- The blood wey flow for Calvary carry healing for body, soul and spirit.
- Sickness na stranger for your body. Command am with the blood!
*5. POWER OF PROTECTION (Exodus 12:13, 23)*
- God tell Moses - when I see the blood, I will PASS OVER you.
- Tonight, put blood for your house, your children, your business. Destroyer no go enter.
*6. POWER OF VICTORY OVER SATAN (Revelation 12:11)*
- Satan na accuser. But anytime he accuse you, blood go show say PAID IN FULL!
- They overcame him by the blood of the Lamb and word of their testimony.
*7. POWER OF A NEW COVENANT & SPEAKING (Hebrews 12:24, Luke 22:20)*
- Blood of Abel dey cry for vengeance, but blood of Jesus dey cry for MERCY, GRACE, FAVOUR!
- Wherever dem dey judge you, blood of Jesus dey speak for you!
*HOW TO APPLY THE BLOOD:*
a) By Faith - Believe am
b) By Mouth -
Advertisement
Event venue
Abuja, Nigeria
Tickets